I went to warri recently if you
see name of churches, ha! my
broda even Satan self dey fear.
Make I yarn una:yo u’ll see
something like this.
{1} SATAN UR OWN DON
KPAFUKA EVANGELICA MINISTRY
{2} Operation carry devil nack
for ground bible ministry.
{3} The atomic bomb bible
brigadia barack ministry *aka*
shoot d devil make im eye clear.
{4}Satan wetin we do you
evangelical church of God.*aka*
Satan leave us alone.
{5} Operation no look Uche face
biblical church of Christ.*aka*
slap Satan face ministry.
{6} Pay your tithe and offering
church of God.*aka* pay ur
tithe n win generator gospeler.
{7} Satan if you try me, you go
hear ween prayer ministry
{8} Satan chop make i chop bible
assemble *aka* we no dey find
Satan trouble ministry.
The next name shock me no be
small ….. . . . .
Bokoharam prayer ministry
devil u go fear. Hey!! Warrrriii!!!
we hail oo
JOKE: CHECK OUT FUNNY NAMES FOR WARRI CHURCHES.

No comments